Gunmen Hang Biafra Flag For Bank After Bullet Kill Two School Children For Ogbunike

Gunmen Wey Pipo Feel Sey Dem Be Members Of Secessionist Group Under Di Proscribed Indigenous People Of Biafra Hang Dia Flag For One First Bank wey dey for Oye Agu-Abagana, Njikoka Local Government Area For Anambra State, in Eastern Nigeria. Dis Na Wetin Pipo For Di Area Tell BBC Ontop Di Incident Wey Happen On Thursday, April 15, 2021.

“Attack No Happen For Any Bank on Thursday, wey be 15th April, 2021 For Anambra State”, Na Wetin Anambra State Police Command Tok As Dem Confam Say Shooting Bin Happen For Di Area but no be for bank.

Tori Be Say Gunmen Wey Reach About 10 in number Dey Shoot Gun For Oye Agu-Abagana. Dem Also Go for Ogbunike And Den Later Enter Ukwo Enugu-Ukwu. As Dem dey Shoot, Stray Bullet Kill Two School Children For Ogbunike. Dem Also Destroy And Burn Two Vehicles For Di Operation.

Spokeperson For Anambra State Police Command wey be Tochuckwu Ikenga, For Statement Wey him Send To BBC Tok Say “To Set Di Record Straight Anambra State Police Command Bin Receive Distress Call On Shootings Close To Oye Olisa Market And First Bank, Ogbunike, wey dey for Oyi Local Government Area of Anambra state for southeastern Nigeria.

“Police Operatives Quickly Mobilize Go Di Area. Di Hoodlums Wey Burn Two Vehicles Run Comot For Di Place As Dem See Police Dey Come. Unfortunately, Stray Bullet From Di Hoodlums Hit Two Students Wey Dey Transit. Dem Rush Dem Go Hospital And now Doctor don Comfam Say Dem Don Die. Meanwhile, We Dey Try Arrest Di Hoodlums.”

No Group Don Claim Responsibility For Di Attack But Gunmen Wey Pipo Never Sabi Don Dey Worry For South East region For Recent Times With Confirmed Incidents For Abia, Imo, Enugu And Anambra States.

[embedyt] https://www.youtube.com/embed?listType=playlist&list=PLGv1uU8_wk7UQOrhFdtpYRCR6jEYABgER&layout=gallery[/embedyt]

Austine Ikeru
Follow Me

Leave a Reply

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

error: Content is protected !!